fbpx
April 26, 2024

Senator Olamilekan Solomon chop knock from NANS on top Education funding

0

The National Association of Nigerian Students, South-West Zone D, don give Senator Olamilekan Solomon wotowoto on to say he yarn for mouth say may federal government komot hand inside funding of university education

Adeola, wey be the Chairman of the Senate Committee on Finance, advice government say make them think well on how e be say nah dem dey fund tertiary institution salary and every other expenses

“Senator Solomon Olamilekan, during an interactive session with revenue generating agencies on 2023-2025 MTEF/FSP, lamented on how some universities dey generate up to N17 billion annually and dem go spend everything without giving reason for the money wey dem spend.

Nah wetin make the Coordinator of the NANS Zone D, Adegboye Olatunji, carry mouth koboko flog the senator well well, say wetin him talk for mouth nah yeye talk….Adegboye advice the  senator make he go read wetin constitution talk on matter of funding tertiary education in Nigeria

The student body vow say if Federal government do anyhow on top this matter, dem go show dem shege on top ASUU strike wey don pass seven month so.

The talk plenti full ground, why not sitdon well read the full tori inside punch READ MORE

 

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *