fbpx
May 3, 2024

Spotify wan sack 17% of dem staff.

spotify-go-reduce-dia-workers

Spotify talk say dem go reduce di number of dia workers by 17% as dem dey try cut cost for di economy wey dey grow slowly.

Even though Spotify make profit of 32 million euros for October, compared to di loss of 228 million wey dem get for di same time last year, di Chief Executive, Daniel Ek talk say e still dey necessary to reduce staff.

Ek talk for letter wey im write to di workers say, ‘I sabi say for many people, di reduction fit dey surprising as we just get positive earnings report and good performance.’

 

FOR MORE NEWS: Kenya Flood: Minister talk say di death toll don rise reach at least 120.

 

E explain say, ‘For 2020 and 2021, we use di opportunity wey lower-cost capital bring and we invest well for team expansion, content enhancement, marketing, and new areas.’

But e talk say now, ‘We dey inside different environment, and despite our effort to reduce cost this past year, di cost wey we get still too much for where we suppose dey.

Spotify go reduce dia workers, You fit go read di tori…READ MORE