fbpx
May 25, 2024

“How church pressure me to marry my best friend” – Stella Damasus reveal

stella-damasus-biggest-mistake

Veteran Nollywood actress, Stella Damasus, don go down memory lane as she open up on di “biggest mistake” of her life.

Di screen diva narrate how di church where she bin dey attend, even be choir member pressure her make she marry her best friend wey be di choir director.

According to di thespian, dem no suppose marry, she tok say as friends dem dey fantastic but as a couple e no work.

She reveal dis tori inside recent chat with popular media personality, Teju Babyface.

Di way wey she take tok am na hin be dis; she yarn say before her  ex-husband, she neva marry any other person, she yarn say e last for eight months.

 

FOR MORE NEWS: “The Only Juju wey I know na Jesus” – Kanayo O. Kanayo

 

Also, she call am di biggest mistake of her life because di guy na amazing guy. But na her friend, her best friend. And religion na hin cause di problem wey make dem marry when dem no suppose marry.

She yarn say dem supposed to be very good friends because as her friend, he dey awesome. But as dem become married couple, nothing work out at all.

You fit go read di tori as Stella Damasus reveal her biggest mistake…READ MORE