fbpx
September 16, 2024

Taraba state Governor don slash state university school fees by 50 percent

Taraba-governor-slash-school-fees

Taraba state governor Agbu Kefas don slash school fees. Na on Wednesday hin order di immediate reduction of school fees for di state university by fifty per cent.

 

Kefas wey pay unscheduled visit to di state university to assess di state of di institution, yarn say hin decide to slash di university school fees to cushion di devastating effects of subsidy removal by di federal government wey don make some of di students no fit pay dia fees.

 

FOR MORE NEWS: Mmesoma: Suspend any action – Reps tell JAMB

 

Also, di Governor discover say a total of 53 courses wey dey offer for di institution no get accreditation. And school fees don increase even poor student hostels join.

Di governor tok say di hostels go experience immediate renovations, so as to improve di living conditions of Students.

Kefas follow order report on why some graduates of di institution no dey go for NYSC or law school when he meet di management of di institution.

Hin tok say di development don become something wey dey very necessary because dem need to ensure say Tarabans get access to Education, without unbearable burdens.

Di Taraba Governor reveal di tori say hin don slash school fees on Wednesday via hin verified Twitter account.

You fit go read di tori…READ MORE