fbpx
December 23, 2024

”I think say I get belle” — Teni don open up

teni-open-up-on-health-challenges

Famous Nigerian songstress, Teni don open up on di health challenges wey she dey struggle with for weeks after she mistake am for belle.

Also, di singer narrate how she bin believe say she fit don get belle. She reason di matter like dat because to chop food and to follow pipo tok kon hard for her.

However, inside di video wey she share on top her Instagram story on Friday, di singer reveal how di body take doher. Also, she reveal di difficulties wey she face as she dey struggle with her health. During dat time, Teni experience both sickness and sadness together.

 

FOR MORE NEWS: Ex-lawmaker, Bimbo Daramola don return to APC

 

In addition, di Sugar Mummy of Lagos express her gratitude to her fans. Aslo, she tell dem make dem thank God on her behalf, as she display di plenty medications wey she take before she eventually recover.

“I am happy today because I feel much better. You guys should help me thank God. I was not feeling well and was sad last week.

“I couldn’t open my mouth last week to talk or eat. I slept to the extent that my eyeballs rolled back, and I kept wondering if I was pregnant,” Na wetin she write be dat.

You fit go read di tori see di as Teni open up on her health challenges…READ MORE