fbpx
May 4, 2024

Tenure limit: Finance ministry order senior directors make dem resign

tenure-limit-for-directors

With di new tenure limit wey dem introduce for directors wey dey di Federal Civil Service, di Federal Ministry of Finance don order all di directors wey don spent eight years for di directorate cadre make dem tender dia notice for early retirement.

According to di memo wey di Director of Administration of di ministry, Mariya Rufai, sign with di date August 3, 2023, di matter bin dey addressed to all directors and heads of units of diministry.

Also, report tok say Office of diHead of Civil Service of di Federation on July 28, 2023, launch ni newly revised Public Service Rules.

Inside di newly revised rules, pesin fit see say di Federal Government introduce new tenure policy for Permanent Secretaries.

 

FOR MORE NEWS:Sylva no get capacity to win election in Bayelsa – APC chieftain

 

Though di rule tok say Permanent Secretaries go spend four years, e still tok say dia tenure dey subject to renewal following evaluation of dia performances. In addition, dem still tok say di directors wey spend eight years go compulsorily retire after di period.

Also, Head of Civil Service of di Federation, Folashade Yemi-Esan, inside memo wey dey addressed to all ministries bin call for immediate implementation of di PSR.

Accordingly, all affected directors dey advised to start di process of documentation with di Administration Department for compulsory retirement by virtue of di section under reference.

You fit go read di tori about di Tenure limit for directors…READ MORE