fbpx
April 27, 2024

BREAKING: Terrorists bomb Jehovah Witnesses Convention

breaking-terrorists-bomb-jehovah-witnesses-convention

Suspected terrorists don bomb one regional convention of Jehovah Witnesses for India, and di matter don leave tears and blood for di religious gathering.

Reporting on di tragic incident, one breaking news on JW.org, di official website of Jehovah Witnesses, yarn say:

“On Sunday, October 29, 2023, at least two bombs explode for di regional convention wey hold for Kerala, India. Di incident happen just after di opening prayer.

According to di first reports about di Terrorists wey bomb di Jehovah Witnesses Convention, two of di Jeovah witness sisters kpai.

At least 55 individuals follow get injury. And na over 2,200 pipo bin dey in attendance. As di matter be so, di police dey investigate di situation.

 

FOR MORE NEWS: ‘Retire from politics’ – Ohanaeze tell Atiku

 

Commenting on di attack, Kerala Director General of Police Darvesh Saheb tell reporters say dem go find out who dey behind wetin happen and dem go take stringent action … preliminary investigation show say na IED [improvised explosive device] blast,”

Videos wey pipo bim film shortly after di explosion and di videos wey dem post online show flames inside di building and rescuers wey dey help clear out.

Meanwhile, Additional Director General of Police (ADGP) law and order, MR Ajith Kumar, tok during one news conference say one person wey hin name na Dominic Martin, claim say hin dey responsible for di explosion, and hin don surrender for di police station wey dey Thrissur district about 65km (40 miles) north from di site of di incident.

You fit go read di tori…READ MORE