fbpx
May 3, 2024

‘Retire from politics’ – Ohanaeze tell Atiku

atiku-retire-from-politics

Di apex Igbo socio-cultural organization, Ohanaeze Ndigbo, don call on di 2023 Peoples Democratic Party, PDP, presidential candidate, Atiku Abubakar, say make hin retire from politics.

Ohanaeze yarn say Atiku lifelong ambition to become president don come to an end.

Di group make di remark as hin dey appreciate di Minister of di Federal Capital Territory, FCT, Minister, Nyesom Wike wey lead di G-5 governors for sinking Atiku ambition.

One of di statement wey dey signed by Ohanaeze factional Secretary-General, Okechukwu Isiguzoro, yarn say make Atiku retire from politics because hin disregard di zoning formula during di last presidential election.

 

FOR MORE MORE: Tinubu appoint Oyedepo as prosecutor for EFCC, six others

 

Also, hin commend former President Olusegun Obasanjo, Afenifere’s leader, Ayo Adebanjo, wey support di Labour Party, LP, presidential candidate, Peter Obi.

Na part of wetin di statement read be dis: “We express our heartfelt gratitude to former President Olusegun Obasanjo, Pa Ayo Adebanjo-led Afenifere, Dr Pogu Bitrus-led Middle Belt Forum, Pa Edwin-led Pan Niger Delta (PANDEF), and all others wey stand firmly in support of Mr Peter Obi.

Also, for di statement dem extend Special appreciation to Nyesom Wike-led G5 Governors for dia instrumental role because hin sink di ambitions of Atiku Abubakar and di Peoples Democratic Party (PDP).

You fit go read di tori…READ MORE