fbpx
April 27, 2024

Tinubu get immediate solution for effect of subsidy removal – Oshiomhole

tinubu-get-immediate-solution-to-fuel-subsidy-removal-wahala

A former governor of Edo state, Adams Oshiomhole yarn say President Bola Tinubu get immediate solution to reduce di effect of di subsidy removal.

Oshiomole tok dis one as hin dey for interview with Channels Television Sunday Politics.

Di former governor express confidence say issues arising from di removal of fuel subsidy go dey resolved between di Federal Government and di organized labour.

However, according to Oshiomhole, Tinubu don see di impact of di withdrawal of fuel subsidy on Nigerians and hin dey determined to take immediate action to reduce am.

 

 

FOR MORE NEWS: Iconic striker Zlatan Ibrahimovic say goodbye to football

 

Oshiomole, wey be former president of di Nigeria Labour Congress (NUC), bin dey part of di meeting between di Federal Government and di Trade Union Congress (TUC) on Sunday.

Also, hin tok say di meeting dey productive, and di government go consider all demands by di TUC and revert on Tuesday.

In addition, Oshiomole yarn say if Nigeria fit save about N7 trillion by ending subsidy, di Federal Government fit take part of dat money put for di wage sector.

You fit go read di tori as Oshiomole yarn say Tinubu get immediate solution to fuel subsidy removal matter…READ MORE