fbpx
May 10, 2024

Peter Obi, LP tender more documents in evidence against Feb 25 presidential election

obi-tender-more-documents

Hearing of di petition of Peter Obi and di Labour Party continue on Monday for di Presidential Election Petition Court, PEPC, and di petitioners tender more documents as evidence.

Mr Patrick Ikwueto, SAN, wey conduct di proceedings for di petitioners tender form EC8A from eight states.

Di documents na certified true copies wey dem collect from di Independent National Electoral Commission, INEC, for 13 local government areas of Ebonyi.

Also hin tender form EC8A for 13 local government areas of Nasarawa, 25 of Delta, 33 of Kaduna State and 21 local government areas of Kogi.

Others na form EC8As for 27 local government areas of Imo, 18 for Ondo and 7 for Sokoto State.

 

FOR MORE NEWS: Subsidy: NLC, TUC don suspend strike

 

All di respondents wey give object to all di documents wey dey tendered yarn say dem go give dia reasons during di final address.

Earlier, Ikwueto, pray say di court go take application to serve interrogatories on INEC.

Ikwueto yarn say di interrogatories contain 12 questions and dem want answers from di commission.

You fit go read di tori as Obi tender more documents…READ MORE