fbpx
May 19, 2024

Tinubu don floor Atiku, Obi, he don win 2023 presidential election

tinubu-don-win-presidential-election

Di presidential candidate of di All Progressives Congress, APC, Bola Ahmed Tinubu don win di 2023 presidential election.

According to di results wey di Chairman of di Independent National Electoral Commission, INEC, Mahmood Yakubu read out, Tinubu poll total of 8,794,726 to defeat hin closest rivals and candidates of di Peoples Democratic Party, PDP, Atiku Abubakar and Peter Obi of di Labour Party, LP wey scored 6,984, 520 and 6,101,533 respectively.

Rabiu Kwankwaso of di New Nigerian Peoples Party, NNPP, score 1,496,687, while di votes of di political parties put together na 666,298.

Di final results wey Nigerians dey wait for don come out, and APC supporters go dey jubilate now as Tinubu don win di presidential election.

FOR MORE NEWS: “Pack your load comot for Lagos,no be your land” – ‘Prophet’ dey threaten Igbos wey dey live for Lagos

Di former Lagos State helmsman follow fulfill di 25 percent votes from 24 States just as e dey specified for di Electoral Act 2022.

Also, di three contenders win twelve states each, including di Federal Capital Territory, FCT, while Kwankwaso clear Kano State.

You fit go see di full tori….READ MORE