fbpx
May 6, 2024

Join me to make Nigeria great – Tinubu dey woo Atiku, Obi

certificate-of-return-be-like-world-cup

President-elect, Bola Tinubu, don call on hin fellow contestants- Atiku Abubakar of di Peoples Democratic Party (PDP), Peter Obi of di Labour Party and others make dem join am make Nigeria a great nation.

Tinubu make dis call for hin acceptance speech after hin dey declared as di winner of Saturday presidential election by di Chairman of di Independent National Electoral Commission (INEC), Mahmood Yakubu.

Di APC candidate Tinubu remind other contestants say Nigeria na for everybody, and make dem join am make Nigeria great.

Also, hin tell di Youths say hin hear dem loud and clear; and together di country go improve. In addition, hin yarn say he go pay undivided attention to dia education. Education loans go dey available, and no more strikes. Our universitiesgo get autonomy. Hin tok say he know where he dey pain everybody; an pipo go see di reward for electing am”.

FOR MORE NEWS: Tinubu victory: Carry am go court no be streets – Buhari tell Atiku, Obi

He describe Nigeria as country wey dey perform wonders for other countries, and hin say we fit do di same thing here.

Also, hin promise say hin go work with everybody to make Nigeria a destination of coming home to contribute to di development of di nation.

As hin dey tok, hin use di opportunity appeal to hin fellow contestants to team up together. He yarn say na di only nation wey we get. Na one country wey dem must build together. Dem go work together to put broken pieces together. He tell dem say dem must work for di unity, happiness and harmony of Nigeria.

Also hin say, weda you dey BATFIELD, ATIKULATE, OBIDIENT, or KWANKWASIYA, you voted and struggled for a better Nigeria.

You fit go read di full tori…READ MORE