fbpx
May 18, 2024

“Men go always break your heart” – Tiwa Savage advise ladies to be independent

tiwa-savage-advise-women

Tiwa Savage, wey be musician from Nigeria, don advise women say e dey important make dem get dia money and make dem stay independent.

Di famous artist recent underline di value of woman independence for concert. Tiwa yarn say since she get her own money, doi only thing we she want  na partner wey fit match her energy.

She tok say lass lass, men go still break women hearts, so, e better to grieve in luxury than cry broken.

Tiwa Savage make dis comment as she dey performing.

 

FOR MORE NEWS: Nasty Blaq splash millions on new Mercedes Benz GLE

 

Also, she yarn say she no dey encourage runs, or make woman dey go after man for hin money. But her point be say e good make woman dey spend her own money. Because as she dey so, she get her own money.

So, she advise women say all dem need na to find partner wey match dia energy because men go still break dia heart anyway. So e better to cry with your Christian Dior-Dior-Dior, your Birkin bag, and your private jet to Dubai”.

You fit go read di tori see as Tiwa Savage advise women during her performance…READ MORE