fbpx
December 22, 2024

I bin dey nervous during my performance for King Charles III coronation – Tiwa Savage reveal

Tiwa-Savage-coronation-performance

Di Superstar singer and queen of Afrobeats, Tiwatope Savage-Balogun, wey dey professionally known as Tiwa Savage, don reveal say she bin dey nervous during her performance for di historical coronation of di British monarch, King Charles III. And she yarn say di feeling almost spoil di moment for her.

Also, di Tiwa Savage gain world dominance as Queen of Afrobeats. Dis na because na she be di only Nigerian artiste wey dem invite to perform for di coronation concert of King Charles III and Queen Camillaat Windsor Castle in England. Of course, na another big win for di talented superstar.

 

FOR MORE NEWS: “I no go ever feature Burnaboy, Davido or Wizkid, I am not interested” – Speed Darlington

 

 

Dis na di first time a Nigerian artist perform for di royal coronation for England, providing a once-in-a-lifetime opportunity for Tiwa Savage.

Also, di event bin dey attended by over 20,000 people and e bin dey widely covered by diBBC, with over 18 million pipo globally wey tune in to watch di concert.

Recently, on top Good Morning Britain TV Show, Tiwa Savage admit say she bin dey nervous in di first few seconds of her performance for Windsor Castle.

Di ‘Queen of afrobeats’, also describe di British Queen Consort, Camilla, as “very lovely” during di show.

Tiwa Savage and di Queen Consort meet before her historic performance for di coronation ceremony.

You fit go read di tori of Tiwa Savage coronation performance…READ MORE