fbpx
May 19, 2024

“Always dramatic every year, I feel for di pikin” — Tonto Dikeh tag Churchill as deadbeat father, netizens don react

tonto-churchill-deadbeat-father

Veteran actress, Tonto Dikeh, don stir mixed reactions after she call her ex-husband, Olakunle Churchill a deadbeat father over hin birthday note to hin son.

Churchill, for hin note, bin use better english express hin emotions to hin son, King Andre, on hin 7th birthday and hin write how much he long to see di boy.

This message trigger long note from Tonto Dikeh where she refer to her ex-husband as a deadbeat father and she drag Churchill mama and wife enter dia matter

Di development don stir mixed reactions from netizens wey support di mother of one because she expressing herself while others condemn her because she dey dramatic.

FOR MORE NEWS: “Una come wedding chop like anything” — Man dey lament over denomination wey guests sprayed am

Reactions to Tonto Dikeh and Churchill ‘s saga

aminashow
“Why drama mut come out every year on this pikin bday abeg make una grow up and co parent in peace haba.”

kosyoluoha
“My first time not minding my business, at this time, weeks to an elections wey go determine di faith of your political engagement you decide to continue to let this guy continue to make you lose control, instead make you focus on more important things. Focus pls your engagement is becoming low.”

ellamills_official_
“Make una carry Una family matter go family meeting we don tire for Una matter for this instagram ahhhh.”

better.call.manny
“I no support deadbeat behaviour. But this stuff go pain di pikin more than di man. Let love lead, hope you find God. Nothing good comes from bitterness and hate. Consider your kids future mental health.”

iamsaylah
“Why is this lil boy birthday always dramatic every year…. I feel for the child tho cuz he’s innocent in all this.”

You fit go see di full gist…READ MORE