fbpx
May 19, 2024

Too much fast fit cause kidney problems – NAFDAC

Too-much-fast-fit-cause-kidney- problems

Di Director-General of di National Agency for Food and Drug Administration and Control, Prof Mojisola Adeyeye, yarn say too much fast fit cause kidney problems.

Adeyeye wey bin dey answer questions from journalists for Abuja on Monday,  yarn say to dey use substandard, unwholesome products fit cause kidney failure and death.

Kidney failure dey happen when di kidneys no fit filter person blood very well again. Na that one go kon make toxins accumulate for inside person body.

“About 869 million people for di world dey suffer from kidney disease. E get tendency to increase fo Nigeria because of pipo lifestyle.” President of di Nigerian Association of Nephrology, Dr Adanze Asinobi  na hin tok am.

FOR MORE NEWS: Banks dey battle shortage of new naira notes ahead of deadline

Meanwhile, NAFDAC DG still yarn say our country dey very religious – Muslims and Christians. We dey fast like  say tomorrow no dey, and na part of wetin dey cause kidney problem.
Di body need to get homeostatic balance. E mean say di water level for di body must dey enough to make our organs function.

Some people go fast for 20 days or 10 days and dem no go drink water even if na small one and dem no know say na di kidney dem dey punished.

NAFDAC DG  yarn say if person wan fast, make dem fast with common sense or else dem go pay di price with dia kidney. Na  wetin make d em tok say too much fast fit cause  kidney problems.

Di NAFDAC boss follow warn say make pipo buy dia medicine only from pharmacists, make dem no buy from hawkers.

You fit go read di full tori…READ MORE