fbpx
May 19, 2024

Nigerian lady don call her papa out over sexual molestation – “My papa deserve death penalty”

Nigerian-lady-don-call-her-papa-out-over-sexual-molestation

One Nigerian lady don go online call her papa out over hin sexual molestation on her. Hin abuse her physically for years. “My papa deserve death penalty”, na wetin she tok be that.

For inside long post wey she share for Twitter, di lady with handle @justsotired__  tok plenty tori about di bad experiences wey she suffer for her papa hand, and she open up on how hin start to dey molesting her from early age.

She yarn say when she report am to di police at age 14, her papa turn di police against her and na so dem lock her up inside cell for one week.

FOR MORE NEWS: Ogun State Government don announce work-free days for PVC collection.

As di Nigerian lady dey tok about di sexual molestation, she open up say she drop out of university because her father bin insist say make she meets am for hotel so that hin go sleep with her before he go pay her school fees.

Di lady wey no happy at all follow call her mama out. She tok say her mama no protec her upon all those sufferness. Her mama even accuse her say she dey jealous of her and her younger sibling.

You fit go read di full tori…READ MORE