fbpx
April 27, 2024

Trailer Crush 8 To Death For Abuja

trailer-crush-8-to-death

According to some report of di trailer wey crush 8 to death for Abuja, di incident happen on Thursday around 4 p.m. before di Keke NAPEP Park along di road wey lead to Mpape junction.

One witness, Mustapha Aminu, bin yarn say di truck crowd some tricycles wey pipo sabi as Keke and vehicles, and na so e kill at least 8 people, including students.

Aminu yarn say di driver, wey see di havoc wey don happen, abandon di truck and hin kon run comot with di help of one motorcycle.

Hin yarn say when di incident happen, hin bin dey close to di road.Also, di incident spoil plenty things.

On top dat one, e kill about eight pipo wey hin count. Pipo bin dey tok say di trailer brake fail. However, hin feel say di thing wey cause di accident na di truck tires wey burst, kon lose control.

 

FOR MORE NEWS: Be like na money be senior” – Reactions as Davido call Tunde Ednut aburo

 

“Nobody hear di horn from di truck, because sometimes when incidents like dat happen, pipo go hear di horn from afar, then pipo go know say dem need to clear road.

If to say di driver do dat one, plenty lives go dey saved.

“More than seven Keke and several cars bin dey affected. About two students for one of di keke die instantly,” Na wetin hin tok be dat.

Confirming di incident, di Sector Commander of di FCT, Chorrie Mutaa yarn say dia rescue team recover five dead body and 10 injured persons. Also, hin add say 13 vehicles, including di truck wey cause di accident and one motorcycle, bin follow dey involved in di accident.

You fit go read di tori of di trailer wey crush 8 to death…READ MORE