fbpx
May 4, 2024

Be like na money be senior” – Reactions as Davido call Tunde Ednut aburo

davido-call-tunde-ednut-aburo

Popular Nigerian singer, David Adeleke, wey dey known as Davido, don stir reactions online after hin call Instagram blogger, Tunde Ednut, “aburo”.

Tunde Ednut sef don enter hin Instagram page to praise Davido as hin study hin new signee, Morravey even as hin inform di public of her upcoming EP.

“Having eyes on good talent and scouting for the best has to be one of the things OBO is good at !!!!
Everybody don Dey wait for you since @morravey”

Responding to di post, Davido thank am inside comments and hin assure am say Morravey go be big deal.

Na hin words be this:

“Thank you aburo mi she’s gonna be HUGE!!”

 

FOR MORE NEWS: BREAKING: Police arrest NLC president for Owerri

 

Di matter don cause stir online, as “aburo” na Yoruba word wey translate to younger sibling. However, research show say Tunde Ednut na 37 years old, while Davido na just 30.

Read netizens reactions below as Davido call Tunde Ednut Aburo:

@abazwhyllzz, “I know you senior me,but I get money pass your papa”

@_oluwaseun9, “be like na money be senior”

@carillanilda, “That “Aburo mi” no really necessary but david na small boy he no get sense”

You fit go read di tori…READ MORE