fbpx
April 28, 2024

I never beat my mother-in-law – Wunmi Toriola

Actress Wunmi Toriola don reply people wey claim say she na violent person and nah why her marriage crash and also she dey always beat her mama, and mother-in-law.

Wunmi Toriola wey debunk this Gossip for her Instagram account yarn say she don hand over bad belle people wey dey talk wetin never happen to God. According to the Actress she yarn say, her marriage don hit zuma rock over a year ago and dem gree to go dia separate ways without any wawulence. She kon dey surprise as her matter come dey trend online on top lies wey never happen.

You go like read: Adeleke Vs Oyetola: Tribunal don fix date for Judgement

First lie wey Wunmi Toriola debunk na say she dey always beat her Mama, she talk say she still dey shock how person go still package that kind lie give people chop. My mama don die 20 years ago, so minus 20 years komot for my age and ask dem at what age I go fit beat my mama wey born me. Moreso, as a Yoruba girl wey dem trained well, I know too well say nah curse for a child to carry hand up beat either her mama or papa.

Second lie: Wunmi Toriola say na lie

Wunmi Toriola also sharperly debunk say she dey beat her mother in-law, she talk say that one nah another big lie from the pit one hell. Thank God my mother inlaw still dey alive, she and my ex-family can testify whether the claim is true or false. It never happens and it will never happen in this life.

She concludes by saying all wey start the rumor and those wey join to spread the lie, God go reward everyone according to wetin dia hand work but as for me I go use all my energy focus on next level, wetin pass don pass. I go advice others too make dem so the same.

Wunmi Toriola married her husband on May 13, 2018 and the union produced a son before the marriage crash for 2021.