fbpx
December 23, 2024

Adeleke vs Oyetola: Tribunal judgment na today, police don warn troublemakers

adeleke-oyetola-tribunal-judgement-today-police-warn-troublemakers

Di Osun State Police Command yarn say dem no go tolerate any troublemakers wey go cause problem for di state as di Governorship Election Petition Tribunal go delivers hin judgment on Friday (today).

Additionally, dem tok say di command don put necessary security measures in place to deal. And dem tok say anybody or any group of persons wey go wan cause trouble go hear am.

As di Tribunal judgment na today, police don warn troublemakers.

For inside statement by di command spokesperson, Yemisi Opalola, on Thursday yarn say police wey dey work with other security agencies for di state no go allow breakdown of law and order for  any part of di state.

FOR MORE NEWS: Adeleke Vs Oyetola: Tribunal don fix date for Judgement

Then, hin guarantee good residents of better security before and after di  judgment.

Therefore, Osun State Police Command dey use di medium beg parents and guardians make dem warn dia children and wards. This na so that dem no go enter trouble/violence.

Hin yarn say make dem no allow bad politicians send dem bad  message wey go cause wahala for di state.

To conclude di statement, di command yarn say dem no go tolerate any kind of thuggery or hooliganism.

You go like go read di full tori…READ MORE