fbpx
May 18, 2024

Fan mock Cristiano Ronaldo with Lionel Messi chants as Al-Nassr lose

al-nassr-lose-and-fans-greet-Ronaldo-with-messi-chants

On Thursday, during di Saudi Super Cup, di Al-Ittihad supporters greet Al-Nassr striker, Cristiano Ronaldo with Lionel Messi chants.

As hin enter di King Fahd International Stadium for di clash, Ronaldo receive surprising reaction from di home crowd.

Di 37-year-old, wey dem don dey treat like royalty since hin make hin big-money move to di Middle East, dey surprise a fans greet am with di chants of hin eternal rival Messi.

Fans greet Ronaldo with Messi chants as Al-Nassr lose 3-1 to Al-Ittihad.

FOR MORE NEWS: Carabao Cup: “You Get Pride” – Roy Keane tell Man utd star after 3-0 win over Forest

Ronaldo bin play against Messi last weekend for friendly, and now, e dey settle into domestic action with hin new side.

However, di evening bin no too good for  Al-Nassr as dem lose 3-1 to Al-Ittihad.

Talisca na hin get di consolation for Al-Nassr, while Ronaldo neva score hin first goal for di club.

Ronaldo, wey dey  under contract with Al Nassr until 2025, make his second start for Al Nassr for dia clash with Al Ittihad for di  King Fahd International Stadium.

Di Footage of di mockery of di five-time Ballon d’Or winner start to trend for social media. E make some pipo wey be Messi fan dey wonder why di Al-Ittihad supporters go dey Ronaldo mock with chants of hin rival even though di Al Nassr crash out of Saudi Super Cup.

You go like read di full tori…READ MORE