fbpx
May 9, 2024

Billionaires wey pay $250,000 each to view di destruction of Titanic ship don kpai after dia submersible explode

billionaires-kpai-after-dia-submersible-explode

Very tragic tori don come out about di billionaires wey pay sum of $250,000 each to view di destruction of di Titanic ship with submersible. Di Billionaires kpai after dia  submersible explode.

According to report, di Titanic-bound submersible wey bin go missing on Sunday with five people on board suffer catastrophic implosion, and di explosion kill all of dem onboard.

US Coast Guard Rear Admiral, John Mauger, confirm di tragic tori on Thursday, June 22. Hin  reveal say di tail cone and various debris, wey matche di characteristics of di missing Titan submersible, na hin dem see about 1,600 feet away from di bow of di Titanic.

Also, hin add say dem immediately notify di families of di deceased. Hin yarn say hin fit only imagine wetin dis matter be like for them and he hope say di discovery go provides some solace during dis difficult time.

 

FOR MORE NEWS: Dani Ceballos don extend Real Madrid deal until 2027

 

Di Titan submersible start to go down on Sunday, June 18, to explore di way wey di Titanic scatter, about 13,000 feet below sea level for di North Atlantic Ocean, with an estimated 96 hours of life support.

Also, dis journey wey dem go na something wey dem bin show as “a chance to step outside of everyday life and discover something truly extraordinary” and each participant pay a staggering sum of $250,000 to be part of dis adventure.

E kon be like say di billionaires pay money to die.

You fit go read di tori see as di Billionaires kpai after dia submersible explode…READ MORE