fbpx
March 29, 2024

U-17: Flamingos Nak New Zealand 4-kondo

0

Nigeria’s U-17 Women’steam, wire Newzealand women wotowoto with 4 -0 for di ongoing U-17 Women’s World Cup for India
Di match wen happen for Fatorda Stadium don make di flamingos to qualify as dem face chile for dier next match.

U FIT LIKE TO READ: Teni Yarn As Naija People Yab Her

.Amina Bello sama di first goal for di Flamingos for 16th minute after di match bigin, Miracle Usani self show her face for di mata as she nak di second goal inside 34th minute.bi for before dem enter half time brake‥

As Newzealand team go say make dem drink water drop cup, for second half,
Taiwo Afolabi self sama dem anoda goal for 75th minute.

Etim Edidiong wen just enter for di second half con show dem say nija na him soccer dey as him self shine him shoe with anoda beta goal.

Fnally opeyemi Ajakaye self con win award for man of di match‥

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *