fbpx
May 19, 2024

Presidential elections: We Don Learned Our Lessons, Glitches Dey Fixed – INEC

INEC-tok-say-dem-don-learn-dia-lessons-and-we-don-fix-glitches-wey-cause-wahala-during-presidential-elections-

Di Independent National Electoral Commission INEC yarn say dem don learn dia lessons from di February 2023 presidential and National Assembly elections and dem don fix di glitches.

INEC National Commissioner, Festus Okoye, tok dis one for on top Channels Television Sunday Politics say “valuable lessons” wey dem learn na hin dem go use for di governorship and state assembly polls next weekend.

Festus Okoye wey be INEC commissioner yarn say dem don put serious efforts to rectify challenges and glitches with di Result Viewing Portal (IReV) ahead of di March 18 polls to avoid matter wey happen during presidential elections.

In addition, Okoye yarn say di ICT department of di commission know wetin dem go do now if any issues come up with di uploading of polling unit results on top di IReV portal for March 18 polls.

FOR MORE NEWS: No court fit upturn presidential result in your favour – Delta cleric tell Obi, Atiku

Di IReV and the BVAS na new technologies wey INEC introduce for di accreditation and electronic transmission of votes for di 2023 general elections.

Also, for di presidential and National Assembly polls, opposition parties complain say INEC officials for di polling units no fit upload election results electronically to diIReV.

Di parties also kick against di manual collation of results and the announcement of winners for di polls.

However, di electoral body promise say dem go fix di glitches but opposition parties don go court to challenge di victory of Bola Tinubu of di All Progressives Congress (APC) wey dey declared president-elect by di electoral umpire.

You fit go read di full tori…READ MORE