fbpx
April 28, 2024

50 years in wilderness await PDP supporters – Aisha Yesufu

wilderness-dey-load-for-pdp-supporters

A social critic and strong supporter of Mr Peter Obi of di Labour Party, LP, Aisha Yesufu don claim say 50 years in di wilderness dey load for di supporters of di Peoples Democratic Party, PDP.

Yesufu statement dey contain inside post via her verified Twitter handle on Monday. Inside di post, she slam di supporters of di PDP over wetin she describe as dia sense of entitlement.

Also, she allege say di PDP supporters go always dey controlled by stomach infrastructure and dem go do things based on wetin dey for dem. In addition, na di reason dem always dey quick to criticise honest work.

 

FOR MORE NEWS: Mixed reactions as INEC drag suspended Adamawa REC, Ari to court

 

According to di social critic, dem feel say Nigerians owe them, and e dey worse because dem feel say dem dey entitled to dia votes.

Na wetin she write dis, “PDP supporters will always be controlled by stomach infrastructure and will do things based on what is in it for them. Reason they are quick to denigrate honest work.

“Worse is their sense of entitlement to Nigerians’ votes. They feel Nigerians owe them. 50 years in the wilderness is loading for them.”

You fit go read di tori see as Yesufu tok say wilderness dey load for PDP supporters…READ MORE