fbpx
April 28, 2024

I no know say Tinubu go be president – Fayose

Fayose-commend-president-tinubu

Governor of Ekiti State, Ayodele Fayose yarn say hin no expect President Bola Tinubu to become Nigeria president, dis na as hin commend president Tinubu.

Fayose remember say hin celebrate Tinubu on hin birthday since 2015, but hin no know say hin go become Nigeria president.

Speaking on Channels Television programme, Sunday Politics, Fayose tok say hin no get regret clamouring for power to shift to Southern Nigeria ahead of di 2023 presidential election.

Also, hin note say hin neva hide hin stance for Tinubu as di leader of di Southwest.

 

FOR MORE NEWS: 50 years in wilderness await PDP supporters – Aisha Yesufu

 

Na wetin Fayose tok be dis: “I have never hidden in my position on Asiwaju Bola Tinubu. Let me remind you very quickly. I never knew Asiwaju will be president of Nigeria and there was no time in 2015, 2016, 2017, and 2018 that I have not celebrated his birthday on the pages of newspapers as the then-governor of Ekiti State.

 

Last week, Fayose visit Tinubu for di presidential Villa for Abuja.

Speaking after di visit, di former governor, Fayose, wey commend president Tinubu, vow say hin go tackle am if hin no keep hin promises to Nigerians.

You fit go read di tori…READ MORE