fbpx
May 9, 2024

Hawaii wildfire death toll hit 55

wildfire-kill-pipo-for-hawaii

Horrific wildfire for Lahaina town of Hawaii, di United States kill about 55 pipo on Thursday, and dat one make am one of di deadliest for di state history.

Brushfires for west coast of Hawaii Maui island break out Tuesday and before pipo know wetin dey happen, di fire destroy di seaside town of Lahaina, according to report from Reuters.

Di flame waka fast and di fire burn plenty pipo off-guard, as dem bin dey trapped inside streets. Some of dem bin try jump inside ocean just to escape from di fire.

 

FOR MORE NEWS: Presidential election: Atiku dey plan to contest again in 2027 – Adeyanju

 

One Canadian tourist, Brandon Wilson, wey travel go Hawaii with hin wife to celebrate dia 25th anniversary, bin still dey di airport dey find flight wey go fly dem out. Also, hin yarn say di town just be like say somebody bomb di place.

Di fires follow other extreme weather events for North America dis summer, with record-breaking wildfires wey still dey burn across Canada and, major heat wave dey bake di US southwest.

Europe and parts of Asia don follow endure high temperatures, with major fires and floods wey dey cause havoc.

Wildfire don kill plenty pipo for Hawaii, destroy dia house, You fit go read di tori…READ MORE