fbpx
May 18, 2024

Comedian Woli Arole pledge to sponsor education of viral “Se fe pami” girl

woli-arole-wan-sponsor-little-girl

Nigerian comedian and actor, Woli Arole don warm di hearts of plenty pipo after hin pledge say hin wan financially sponsor di little girl wey go viral as she dey lament bitterly to her mama.

Di yet-to-be identified girl don become internet sensation when one video of her go viral. For inside di video, di girl bin dey ask her mama weda her mama wan kill her.

But di matter wey make di girl dey lament no dey clear. Di girl bin dey serious as she dey follow her mama tok.

 

FOR MORE NEWS: US Billboard Chart: Rema ‘Calm Down’ don become first song to spend one year on chart

 

In reaction to di video, Woli Arole take to hin Instagram page reveal say di video dey very entertaining. Also, hin reveal hin intention to sponsor di girl education and general welfare.

In addition, as Woli Arole tok say hin wan sponsor di little girl, hin don encourage anybody wey know di girl mama and papa say make dem try reach out to am so dat hin go meet with dem, and hin go fit tell dem hin desire to sponsor her.

You fit go read di tori…READ MORE