fbpx
September 29, 2024

Kate Henshaw don react to di viral video of one woman wey strip herself naked for bank.

woman-strip-herelf-naked-for-bank

One of di latest trending video na di video of one young woman wey strip herself naked for inside di Bank hall. Di video don go viral for social media, and e don make plenty pipo dey tok.

For inside di video, pipo see a di woman comot cloth for her body, strip herself naked for Access bank hall as she dey demand for all her money wey dey inside her account. She follow tok say make dem closure di account after dem give her all her money.

Also , di lady bin dey wea only a brassiere for di  upper part of her body and her shorts. As he dey there, she dey vex dey para for di inside di Access bank hall.

FOR MORE NEWS: “Congratulations, I see double blessings from God” – Womb watchers don dey congratulate Mercy Chinwo as she share new photo

With Yoruba language, she say “Make una close my account, I no dey ue am again. My children no go school yesterday; I no dey us am again.”

However,  actress Kate Henshaw don react to di viral video. She advise pipo make dem stop to dey share di video because di woman bin dey frustrated. She follow tok say di woman bin no get choice but to strip herself naked so that she go get her money from di bank.

“ABEG MAKE UNA NO SHARE THAT LADY’S VIDEO..

SHE NO GET CHOICE BUT TO STRIP HERSELF TO GET HER OWN MONEY BECAUSE OF MEFFY AND HIN COHORTS..

WE GET CHOICE ..TO COVER HER NAKEDNESS AT LEAST. ABEG..” Na wetin Kate Henshaw tok be that.

You fit go read di tori…READ MORE