fbpx
May 18, 2024

Yul Edochie and Judy Austin react after May Edochie file N100 million lawsuit against Judy

yul-edochie-and-judy-lawsuit

Yul Edochie and Judy Austin don react after May Edochie file N100 million lawsuit against her husband second wife.

Also, May wey dey represented by Femi Falana and Eculaw group dey demand for N100m in damages from Yul and his second wife, Judy, wey she accuse of adultery.

Di DPA Family Law Clinic wey share update on di couple marital crisis, yarn say Judy and Yul dey aware of di lawsuit, as dem receive copies of di suit papers by email.

Also, another claim tok say “both Yul and Judy dey avoid service of di process upon them.

Di court bailiff don try plenty times to serve dem in accordance with di rules of court, but dem don escape service of court process.

Upon all di bragging and di social media stunts, Yul Edochie and Judy still dey facing serious legal challenges and dem no do like say dem dey ready.

 

FOR MORE NEWS: “All your chicks dey my Dms” – Halima Abubakar call out Apostle Suleman again

 

Also, May don file for an order of court restraining Yul from accessing dia former matrimonial home.

Di businesswoman wey cited safety concerns, claim say di actor dey act irrational, aggressive and increasingly threatening.

She yarn say Yul dey act like say hin dey under some influence.

May yarn say she dey take measure to protect herself and her children.

As di matter be now, dem don tell di actor make hin consult hin lawyer, and make di lawyer guide am on wetin to do.

However, on lawsuit wey dey ground, an unbothered Yul and Judy Austin share post on top Instagram dey dancing to Flavour song with the lyrics ‘Na we dey in charge’.

You fit go read di tori…READ MORE