fbpx
April 28, 2024

Yemen: Over 80 people die for Ramadan stampede

80-pipo-die-for-yemen

Officials don confam say tragedy hit di Yemen capital Sanaa, and at least 80 pipo die for inside horrific crash for school during di distribution of charity for Ramadan.

Viral video footage on social media show di kata kata scenes after di incident for di Bab-al-Yemen area of di city.

According to di BBC, hundreds of pipo rush enter di school to receive gifts and donations of about $9 (£7) per individual.

FOR MORE NEWS: May 29 Inauguration: Tinubu whereabout don raise controversy

Since 2015, Houthi rebels don take charge of di city after dem drive out di government.

Also, di interior ministry reveal say those wey dey responsible for di distribution dey detained, and investigation dey underway.

A spokesman for di ministry blame di stampede on di “random distribution” of funds without coordination with local officials.

A health official for Sanaa yarn say plenty people follow get injury, with 13 for critical situation.

Rescue efforts dey ongoing at di time of filing dis report.

You fit go read di tori of di news wey 80 pipo die for Yemen…READ MORE