fbpx
May 9, 2024

12.5kg cooking gas price fit hit N18,000 December

Gas retailers don warn say di price of 12.5kg cooking gas fit hit N18000 by December if di Federal Government no limit di activities of di terminal owners.

Also, di President, Nigerian Association of Liquefied Petroleum Gas Marketers, Olatunbosun Oladapo, yarn on Sunday, say di price of Liquefied Petroleum Gas wey pipo sabi as cooking gas don  “dey high for terminals because of di sudden increment from between N9-N10m per 20 metric tons to N14m per 20 metric tons.

Hin tok say di terminal owners dey “hide under di guise of high foreign exchange to increase price to further increase di suffering of di masses.

Olatunbosun yarn say dem no get any justification for di increment, as di Nigerian Liquefied Natural Gas Limited still supply di market.

 

FOR MORE NEWS: Justice for MohBad – Bella Shmurda don vow

 

Hin yarn say NNPCL now dey take 59 per cent of di gas wey NLNG produce, although NLNG don follow increase di price from N6m to N8m. Now, because NLNG don increase price, NNPCL and terminal owners don follow increase price to N14m.

In addition, hin tok say di ordinary man no go fit buy gas. Hin ask say how many minimum wage earners fit afford gas now? Everybody dey turn to firewood and charcoal.

Also, di surprising thing be say dem visit President Tinubu last week, and promise say dem go work together with hin administration to make life better. Now dem don come back dey do another thing.

You fit go read di tori of dis matter of cooking gas wey fit hit N18000 by december…READ MORE