fbpx
May 4, 2024

Justice for MohBad – Bella Shmurda don vow

justice-for-mohbad-bella-shmurda-don-vow

Popular singer Bella Shmurda don vow to get justice for hin late friend, MohBad.

However, na few days after hin friend kpai, na hin Bella Shmurda decide to break hin silence on di death of hin friend.

Inside one statement wey dey on social media app, X, Shmurda, wey be musician, claim say Mohbad spirit no allow am rest since hin kpai.

Also, hin call on police say make dem arrest Marlian Record CEO, Naira Marley, and another of hin associates, Sam Larry.

Dis na wetin Shurmda write for hin post: “For di past few days I don try my best make I no carry phone type anything.

 

FOR MORE NEWS: Electric shock Midnight thief to death for Unizik

 

In addition, Shurmda tok say Mohbad spirit no let am rest as hin know say na only him fit calm hin spirit down, by making sure say di pipo wey make am live in fear no get rest too.

“And he don start. Yes, I mean wahaLa just wan start like this. I NO GO GREE.

 

Also, hin tok say Samlarry and di whole Marlians music go dey arrested. Hin tok say make everybody Dey police and if di Nigerian police dey too weak as body to fish these people out, dem go do am street, legal or illegal.” Na wetin hin tok be dat.

Shmurda don vow to get justice for MohBad, You fit go read di tori…READ MORE