fbpx
April 19, 2024

2023: PDP don appoint Tambuwal, Udom as Atiku campaign DG, chairman

0
Tambuwal-

Nigeria main opposition party, the Peoples Democratic Party (PDP), don name di Governor of Sokoto State, Aminu Tambuwal, as di Director General of dia 2023 Presidential Campaign Organization (PCO). Di party follow name  Governor of Akwa Ibom State, Udom Emmanuel, as di chairman of di Presidential Campaign Council (PCC).

YOU STILL FIT READ: Court order INEC make dem accept Akpabio as APC senatorial candidate

Di party get Atiku Abubakar as dia presidential candidate for di election wey dem put for 25 February, next year. Before, Atiku be di  country vice president between 1999 and 2007.

Di gist wey dey people mouth early this week be say Mr Tambuwal don step down as di chairman of di party governors forum even as di party dey deal with internal crisis.

You fit CLICK HERE go read more of di tori.

 

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *