fbpx
April 25, 2024

2023: Peter Obi movement go change Naija – Pat Utomi

0

Di Professor of political economy, Pat Utomi don talk hin mind sey di 2023 general election go born better pikin for Nigeria as hin mention sey di Labour Party presidential candidate, Peter Obi’s movement go change Nigeria wella.

Utomi wey yarn Nigerians wen hin dey talk on top channel political show wey Tori pipu monitor on Sunday talk sey Nigerian politicians no know pass deir own betterment sey dey no dey remember di pipu at all.

YOU FIT LIKE READ: Full list: Wizkid and other artist wey win for Headies 2022.

Hin talk sey di goal of di Waka waka wey Labour Party do na to address wetin make Democracy work.

Utomi kon add am join sey di reason wey make Nigeria be like this na because pipu wey dem dey put for di position no know pass deir own mouth and belle leaving di poor pipu to suffer. Oya check here to read di tori

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *