fbpx
April 24, 2024

Golden girl Amusan win Berlin meet

0

World record holder Tobi Amusan don dominate di women’s 100m hurdles for di ISTAF 2022 Berlin meeting for Sunday as she take win for a time of 12.45 seconds, di meeting na part of di World Athletics Continental Tour Silver level series.

YOU FIT LIKE READ:Buju BNXN win headies’ next rated category 

Amusan wey enter Sunday race for di back of a second-place performance at di 2022 Lausanne Diamond League meeting last month, talk sey hin dey confident of bouncing back for di Olympic stadium dis weekend.

Our own Nigerian standout reach a strong start to build a sizeable lead before hin kon run sote hin kon secure victory.

Amusan wey hit di last hurdle before hin start to Dey breath fukefuke talk sey hin dey okay wella sey Wetin dey hin mind now na to dey ready for her next competition at di 2022 Wanda Diamond League final in Zurich later dis week.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *