fbpx
April 26, 2024

2023: Your days are numbered – PDP clear APC for Jigawa state

0

Di opposition Peoples Democratic Party (PDP) don come out tell di ruling party wen bi All Progressive Congress say dia day are numbered, for dis coming 2023 election nothing dey for dem .

Di gubernatorial candidate of di party for Jigawa state, Dr Mustapha Sule Lamido yarn dis one on Tuesday, for di flag-off of di 2023 election campaign wey sele for Dutse, di state capital.

U FIT ALSO READ Buhari-led administration don fully implement di demands wey EndSARS protesters present – FG

Hin tok say di ruling party for jigawa state and di countri no get anything to show rather dan to cause unnecessary difficulties and hardship for dia citizens.

Lamido tok say na PDP be di only party wey dey readi to provide solutions to di problems wey dey for di countri.

Hin tok say with di kind crowd wey dey for di occasion e don dey clear with all indication say pipol of di state don alreadi make up dia mind say na PDP dem want.

Hin con predict say 2023 na di final bus stop for APC both for dia state and di countri in general.

To read di full tori CLICKHERE

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *