fbpx
May 2, 2024

4.8m Fresh BVN Registrations na hin bank record for 2022

4.8m-Fresh-BVN-Registrations

4.8m Fresh BVN Registrations na hin bank record for 2022. According to data wey Nigeria Inter-Bank Settlement System (NIBSS) release, dem say di NBanks for Nigeria record total of 4.8m Fresh (BVNs) Bank Verification Registrations for 2022

Di Bank Verification Numbers (BVNs) registration for di country don increase to 56.5 million. Di increase dey notable compared to 51.7 million BVNs wey dey registered as of December 2021.

But NIBSS don look am say di 2022 figure show slowdown for di BVN database growth unlike how e be for 2021 when di database bin increase by six million from 45.7 million in December 2020 to 51.7 million.

FOR MORE NEWS: January 31 deadline no sure, experts warn CBN

Bank Verification Number na unique number wey dey allow pipo accounts dey verified across Nigerian banking industry. Na for inside bank  pipo dey go collect their ID. This BVN dey unique to one person. When customer enter bank, di first thing wey dem go do na to enroll for BVN, after that one, dem go fit link am to all di bank accounts wey dem get for Nigeria.

NIBSS say BVN issue bank account owners unique identity wey fit dey verified across di Nigerian banking industry.  E go make sure say bank user dey protected from unauthorised access.

Dem tok about di security benefits of di BVN.

You go like read di full tori about di 4.8m Fresh BVN Registrations wey bank record for 2022 …READ MORE