fbpx
May 5, 2024

80-year-old man kpai inside Kano well

80-year-old-man-kpai-inside-kano-well

One 80-year-old man, Malam Rabiu, wey pipo sabi as Na Allah Siraka don kpai inside well wey dey Sabon Sara, Gidan Aminu Ado, for Gwale Local Government Area(LGA) of Kano State.

Na inside statement from newsmen by di Public Relations Officer of Kano State Fire Service, Alhaji Saminu Abdullahi on Sunday na hin dem confirm di tori for Kano.

Abdullahi yarn say di incident happen on Sunday morning.

According to wetin hin tok, dem receive emergency call at about 11:00 a.m from one Hassan Abduallhi, say one man dey trapped inside well.

 

FOR MORE NEWS: $10bn debt: CBN neva pay banks, dollar don near N1,000

 

Hin tok say dem immediately send dia rescue team to di scene at about 11:07 a.m.

Abdullahi yarn say di Malam Rabiu bin dey live alone for hin house.

Di PRO yarn say fire service rescue team na hin carry Rabiu dead body come out from di well dead.

Also, di spokesperson yarn say dem hand over di victim to Ward Head of Sabon Sara, Alhaji Muhammad Salisu-Iman.

Abdullahi tok say di cause of di incident dey under investigation. Na di tori wey dey on ground be dat.

80-year-old man kpai inside well, You fit go read di tori…READ MORE