fbpx
May 5, 2024

Regina Daniels reply pipo wey question her decision for marrying her husband

why-regina-marry-ned

Notable actress, Regina Daniels don explain di reason why she marry her billionaire husband, Senator Ned Nwoko, as hin sixth wife.

Di young actress and mother of two take her time explain why she chose to marry her husband wey use plenty years senior her and wey get five wives already before hin marry her.

She use popular soundtrack explain say bullion van no dey physically attractive.

However, if person enter inside, dem go see di real beauty of am – dis na reference of how wealthy her billionaire husband be.

She captioned the video …

“Me to the people still questioning my decision in marrying my husband”.

 

FOR MORE NEWS: Dangote group deny cement price slash

Check out netizens reactions …

@Yella112: “Normally na only you and ivy ifeoma fit advice me for dis life”

@PRINCESS ask: “Is your husband father still available help a sister”

@Jennifer comment: “na u n ivy ifeoma be legend”

@Hair_by_nanya“Omo ma only u and Ifeoma make the best choice for this country”

@cherish“Incase your husband want another wife abeg I Dey ohh na me first beg you ohh. i promise to respect you as my senior wife ”

Why Regina marry Ned, You fit go read di tori…READ MORE