fbpx
May 5, 2024

Again, national grid collapse five days after restoration

national-grid-collapse-again

National grid don collapse again, just five days after dem restore am following similar incident wey lead to a total blackout across di kontri.

Data from di system operator show say power generation drop from 3,472 MW around 11 a.m. on Tuesday to 88.70 MW in di afternoon.

Also, di generation data show say only Afam VI (GAS/STEAM), Azura-Edo IPP (GAS), and Delta Gas contribute to di grid at the time.

However, as of 7 p.m., generation increase to 1,914.60 MW with 12 generators on the grid.

Di contributing generators na Afam VI (Gas/Steam), Azura-Edo IPP, Delta Gas, Egbin (Steam), Geregu (Gas), Kainji (hydro), Odukpani (NIPP), Okpai (Gas/Steam), Olorunsogo (gas/steam), Olorunsogo (NIPP), Trans-Amadi, and Omotosho (Gas).

 

FOR MORE NEWS: Peter Obi storm Supreme Court To Nullify Tinubu Election

 

Although di Transmission Company of Nigeria (TCN) neva react to di development, di grid collapse two times on September 14, 2023, marking 421 days since di last incident bin dey recorded.

As dem confirm di incident inside statement wey di spokesperson, Mrs Ndidi Mbah issue, di company attribute di collapse to fire incident for Kanji/Jebba 330 kV line 2.

Also, di spokesperson tok say dem dey investigate di matter so dat e no go happen again.

National grid collapse again, You fit go read di tori…READ MORE