I lost millions trying to feature Nicki Minaj – Iyanya
Nigerian singer, Onoyom Mbuk, wey dey known as Iyanya, don narrate how him and hin team lose millions of naira inside failed bid to feature famous American-Trinidadian, Nicki Minaj, for one of hin songs.
Di former project Fame West Africa winner yarn say after di success of hin breakthrough song, ‘Kukere’, him and hin team dey under pressure to produce di next big single.
Iyanya explain say hin don already record ‘Flavour’ but hin feel say no be dat one go be di next single after ‘Kukere’.
As Iyanya narrate how hin lose millions, hin yarn say hin producer, D’Tunez change di beat for Kukere and hin use am make ‘Your Waist’, wey kon get plenty airplay.
FOR MORE NEWS: Na song I sing I no kill person – Obidiz react to Mercy Chinwo lawsuit threat
According to am, hin team bin no dey satisfied with di traction of di song, so hin record label boss, Ubi Franklin, suggest a remix with Nicki Minaj to boost di success of di song.
Hin yarn say hin fly go Atlanta, United States, to meet Nicki Minaj for di feature, but dey tell am say e go cost $200,000 to sign her to a song, and dat time dem no fit afford di money.
“Ur waist was so massive we decided it should go international and we needed the right artiste to help with that journey. @ubifranklin1 suggested Nicki Minaj and I asked how we’re gonna pay for that, he laughed and said ‘if your dreams don’t scare you, they aren’t big enough.” Na wetin Iyanya tok be dat.
You fit go read di tori…READ MORE