fbpx
May 18, 2024

Na song I sing I no kill person – Obidiz react to Mercy Chinwo lawsuit threat

obidiz-react-to-mercy-chinwo-lawsuit

Afrobeats artist, Obi Lawson, wey dey known as Obidiz, don finally react to di threat by Gospel singer, Mercy Chinwo to file a N2 billion lawsuit against am for name-calling.

Remember say Mercy Chinwo through her lawyer, Pelumi Olajengbesi, bin write to Obidiz. And she order am say make hin take down hin song entitled ‘Mercy Chinwo’ from all music digital platforms for using her name and image for secular music audio and video.

She warn am say failure to do so go attract legal action and she go approach court to award N2 billion damages against am.

As Obidiz react to Mercy Chiwo lawsuit via hin Twitter page on Saturday, hin yarn say na only song hin sing. Hin add say  hin no commit murder.

Also, hin explained say di song na about one lady wey hin meet.

Hin write, “Na song I sing I no kill person.

“Mercy Chinwo for church o but for club na Cardi B set’ Talks about a girl I met, na she I sing about but una wan crucify me,” na wetin Obidiz tok be dat.

You fit go read di tori…READ MORE