“Respect my wife privacy” – Davido don give serious warning to blogger
Nigerian superstar singer David Adeleke, wey dey professionally known as Davido, don give serious warning to popular Instagram blogger regarding hin wife, Chioma.
Dis matter dey come after di blog post video of di singer wife. Di blogger claim say she don get belle and she dey expectanother pikin with am.
Also, di video show Chioma, wey no dey for social media since di death of her son with Davido, Ifeanyi, in October of last year, with a visible baby bump.
FOR MORE NEWS: Super Eagles coach Peseiro dey find local players for NPL Super Six playoffs
As Davido see dis one, through di comment section, hin tell di blogger make hin delete di video and hin reveal say na old clip.
In addition, hin tell di blogger make hin respect hin wife privacy. “Delete the old video and respect my wife’s privacy. Thank you.” Na wetin di Timeless star write be dat.
You fit go read di tori wey Davido give serious warning to blogger…READ MORE