fbpx
November 22, 2024

Davido splash N577M to get ‘Timeless’ diamond pendant

davido-timeles-diamond-pendant

Prominent Afrobeats singer, Davido don get ‘Timeless‘ diamond pendant, and according to report, di pendant cost over half a billion naira.

Di singer take to hin Instagram page to share di moment when dem unveil di luxury jewelry.

Inside video wey dey on top Davido page, person carry di diamond pendant wey dey packaged inside secure box give di singer make hin wear am.

 

FOR MORE NEWS: Bobrisky cancel birthday plans following hin papa death

 

Di diamond pendant dey designed in honor of Davido record-breaking album, Timeless. Also,  hour glass dey di body and na tiny bits of diamonds full am.

As dey dey Satisfied with wetin hin see, hin tok say hin don turn sand to diamonds, dat statement make people wey dey there start to laugh.

Rumour wey don go round yarn say di  jewelry cost a shocking £500,000, wey translates into millions for Nigerian naira.

You fit go read di tori…READ MORE