fbpx
May 18, 2024

Video of Destiny Etiko and James Brown on boat cruise stir reactions

destiny-and-controversial-crossdresser

Destiny Etiko, wey be Nollywood actress and producer, and controversial crossdresser, don continue to raise heads and reactions with dia show.

Inside recent video from Etiko friend birthday boat excursion wey surface online, Destiny Etiko wear white bikini with her girls and James Brown, wey joins di ladies for dia activities,

Destiny Etiko and James Brown bin just dey play, and dem dey vibe together, as if dem no be opposite gender, that is, Man and woman.

Also, one of di video show James Brown as hin put hin head between Destiny thighs as dem dey have fun.

Destiny Etiko, on di other hand, bin dey softly slide her hand for James Brown back as hin dey twerk and whin hin waist.

 

FOR MORE NEWS: Davido splash N577M to get ‘Timeless’ diamond pendant

 

Captioning di video, Destiny write:

“Partied so hard with my girls in the YATCH Still celebrating my girl’s BIRTHDAY @jaykneeeeephaaaaaar.”

Netizens reactions…

However, di video don generate plenty reactions from fellow celebrities and fans.  Dem express dia thoughts as regards Destiny Etiko and James Brown jokes in recent times.

You fit go read di tori see reactions from netizens on dis matterof Destiny and controversial crossdresser…READ MORE