fbpx
April 30, 2024

Vote for anybody wey You Like, Buhari Tell Nigerians

0
Buhari-advise-Nigerians

He yarn say dem no go allow anybody rally resources and thugs to take threaten people for any constituency. Na for London on Wednesday evening hin drop di update after hin meet King Charles III for di Buckingham Palace. Mr Buhari yarn say hin aim na to make sure Nigerians believe say dem dey respected as an administration.

President yarn say as Leader wey hin be, na wetin hin want make e go down for Nigerian history.

Hin express confidence say di ruling All Progressives Congress (APC) and dia presidential candidate, Bola Ahmed Tinubu, go win di election. 

YOU GO LIKE READ: Copywriting tips for beginners: The 5 Ultimate Guide

According to am, APC dey lucky to have Tinubu as dia presidential candidate.  When dey ask am about di chances of APC to win for di 2023 elections, Buhari say: “We’re going to win the election”.

Hin still yarn say “Tinubu, di presidential candidate, a very well-known politician for di country, na two-term governor for Lagos State, di most resourceful state and di most visited state. So, hin think say di party dey lucky to get am as dia candidate.

Di president yarn say hin meeting with King Charles focus on strengthening bilateral relationship with di United Kingdom.

This tori berekete for inside DailyTrust, you fit go read di remaining…READ MORE

For more news: Hoodlums attack Atiku campaign convoy for Borno

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *