fbpx
April 16, 2024

DSS operative jump inside lagoon

0
DSS-jump-inside-Lagoon

One beautiful Nigerian lady, wey dey identified as Adetutu Adedokun, jump for Third Mainland Bridge enter inside lagoon for Lagos on Thursday, November 10.

Adetutu, an operative of di Department of State Services (DSS), wey dey for her thirties, na hin dem talk say she come down from  cab wey she bin dey, waka go di railing of di bridge, before anybody know wetin dey happen, di lady jump enter inside water.

Di cab driver claim say di lady bin get serious argument with her fiancée before she comot from hin cab go jump enter inside lagoon.

YOU GO LIKE READ: 9 Tips to Stay Productive at All Times

Di Permanent Secretary, Lagos State Emergency Management Agency, Dr Olufemi Oke-Osanyintolu, wey confirm di incident, yarn say dem don send search and rescue teamwey go look for di woman.

As di matter be so, di rescue team no see her body on Thursday and the search go continue today wey be November 11.

Di state Commissioner for Information and Strategy, Gbenga Omotosho, na hin talk this one.

Information wey come out show say di lady and her fiancé do engagement a few weeks ago and dem even share proposal video online.

Na inside Yabaleftonline this tori dey, you fit go see am there…READ MORE

For more news: Rema ‘collapse’ on top stage when hin dey do hin UK concert

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *