fbpx
April 30, 2024

“Davido no be your mate oo” – Davido fans dey tell Rema

0
rema-davido.

Fans of di singer, David Adeleke alias Davido don descend on di youngster, Rema because of hin birthday message to di crooner.

Davido wey turn 30 yesterday, 21st November even as hin don dey silent all this while because of hin pikin death, Ifeanyi, still dey celebrated by fellow celebrities and fans all over di world.

YOU GO LIKE READ: Online Marketing Guides for Pharmacists

In line with this, Rema enter hin official Twitter handle, hin write short note for di singer. But Davido fans see di note as disrespectful.

As Rema Share photo of himself and di singer, hin write:

“Love you OG ❤️@davido”*

Some of di tweets wey di Davido fans comment na hin be this:

@Hojay_Sax wrote: “You’re Ryde…you can’t put boss..na Davido be OG. All this 2000 children sef”

@otunbaseafood wrote: “You no they fear, na 001 you they call og abi? Davido no be your mate oo”

This tori dey inside Gistlover…READ MORE

For more news:  Shey hin don come back for hin 3oth birthday? Different reaction don full internet as Cubana Chiefpriest post video with Davido

 

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *